Ministerial List: Positions Buhari give di seven women for im cabinet

Women ministers

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Newcomers Gbemisola Saraki and Ramatu Tijani Aliyu go join Zainab Ahmed (centre) wey bin dey Buhari cabinet before
Read am in 2 mins

Nigeria President Muhammadu Buhari don give 43 new ministers dia porfolio - dat na di ministries wey dem go occupy.

Na on Wednesday di Nigerian presido swear dem in and give dem positions for ceremony wey happun for State House Abuja.

Among dis 43 ministers wey take dia oath of office, seven of dem na women.

Di ministries wey di seven women occupy

Grey line wey dey
  • Sharon Ikeazor - Minister of state for Environment
  • Gbemisola Saraki- Minister of state for Transportation
  • Dame Pauline Tallen - Minister for Women Mata
  • Ramatu Tijani Aliyu - Minister of state for Federal Capital Territory
  • Maryam Katagum - Minsiter of state of Industry, Trade and Investment
  • Sadiya Umar Faruk - Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development
  • Zainab Ahmed - Finance, Budget and National Planning.
Buhari minister

'Tins no change'

Work go start sharp-sharp for members of president Muhammadu Buhari cabinet afta dem take oath of office and collect dia portfolios today, 21 August.

According to di president di new ministers go work closely with Permanent Secretaries dem for dia ministries.

Women's Affairs Journalist for BBC Africa Azeezat Olaoluwa say, many pipo see di appointments of dis new ministers wey dem come almost three months afta di president take oath of office for im second term as improvement from im first term wia e take am six month to form im cabinet.

But e be like say tins no change for di slots women get for Buhari administration. Only seven women dey Buhari cabinet and four of dem get junior positions.

Many Nigerians dey para since di list comot say di president break im promise

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Im bin promise to implement di National Gender Policy wey dem pass into law for 2006 and also promise to appoint 35% women for ''im Covenant with Nigerian'' document for 2015.

No be today women representation for goment dey low na from former president Olusegun Obasanjo regime.

But dis na di poorest records for women for goment whether na elective positions or appointments. Olaoluwa add.