Ministerial list: Buhari, Akpabio, Fashola and oda ministers wey collect big position

President Buhari, Akpabio and Fashola

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, President Buhari, Akpabio and Fashola

Nigeria President Muhammadu Buhari on Wednesday announce position for di 43 new ministers wey im swear in on Wednesday for Abuja.

President Buhari make pipo laugh for di room wen im announce say Timipre Sylva of Bayelsa state, go work as di minister of state under am.

With dis announcement, President Muhammadu Buhari follow di leg im carry for 2015 wen im assign minister of state to work, while he imsef go oversee di ministry.

Oda pipo like di former govnor of Akwa Ibom state Godswill Akpabio collect di position of Niger Delta minister, while Chris Ngige retain im position as minister of state for Labour and Employment.

Di new ministers go follow President Buhari and im vice Yemi Osinbajo carry Nigeria go di next level dia campaign slogan during di election.

President Buhari, Vice President Yemi Osinbajo with di 43 new ministers

Wia dis foto come from, Government of Nigeria

Wetin we call dis foto, President Buhari, Vice President Yemi Osinbajo with di 43 new ministers

See di full list of di 43 ministers and dia Portfolios

Ministerial list

Wia dis foto come from, Other

Ministerial list

Wia dis foto come from, Other