Maxim Dadashev die afta im injure for boxing ring

Wia dis foto come from, Getty Images
Russian boxer Maxim Dadashev don die for di age of 28 afta injury wey im suffer from IBF light-welterweight fight against Subriel Matias.
Report say Dadashev no even fit waka go di dressing room afta trainer Buddy McGirt stop di fight for di end of di 11th round on Friday.
Dem rush am go hospital wit bleeding for im brain and dem even do emergency surgery for am but e fail to recover.
Russian Boxing Federation tok say dem don open investigation on top di mata.
Secretary general Umar Kremlev suggest say e be like say "some kind of violation dey".
"We lost Maxim Dadashev. E be our young prospect."
"We go fully support im family, including to helep dem wit money. We go complete di investigation on top wetin happun for di fight wey lead to im death, we need to know di truth about wetin happun."
"Dis dey happun for any sport. I tink some human factors chook mouth inside, some kind of violation happun."
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Dadashev wey dey stay for America don win all of of im 13 fights but im collect plenti-plenti punches from di Puerto Rican boxer, Subriel Matias during di fight wey happun for Maryland.

Wia dis foto come from, Scott Taetsch
Im trainer, McGirt bin tok afterwards say e "no fit convince" im fighter to stop, but decide say dem no do again afta e see say "more and more clean shots dey hit im face as di fight continue".
Russian Boxing Federation tok say afta di fight, Dadashev condition come worse more-more and doctors come find out say e get cerebral edema and dem come do very difficult operation for am, but im heart stop to dey beat on Tuesday.












