You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kidnapping: Police confam fresh kidnap along Lagos/Ibadan Express way
Nigeria Police don confam to BBC Pidgin say jaguda pipo don kidnap some pipo for Lagos/Ibadan Express way.
Abimbola Oyeyemi of di Ogun State Police Command tok say di gbege hapun between 7.30pm and 8.00pm for Tuesday around di Ogunmakin forest area of di highway.
"Some travellers dey go through Lagos-Ibadan Expressway and as dem reach Ogunmakin area, jaguda pipo comot from bush come attack di vehicle. As I dey follow you tok now, we get report say dem don abduct 3 of di passengers and dem don carry dia car come police station"
Oyeyemi wey be PRO of Ogun State Police Command add say two of di passengers wunjure and dem don carry dem go hospital.
Oyeyemi add say police for Ogunmakin Police Station for Ogun State don recover di vehicle where di passangers bin dey travel wit before di kidnap.
Commissioner of Police for Ogun State, Bashir Makama don deploy security to di place led by di Deputy Commissioner of Police for Operations to try rescue di pipo wey dem kidnap, Oyeyemi Add.