You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Shiites protest in Abuja: Protesters enta street again on Tuesday afta bloody clash on Monday
Upon say e turn bloody clash between members of di Islamic Movement of Nigeria and Police on Monday for Abuja, di religious group hit di dey street again on Tuesday to demand for di release of dia leader, Sheikh Ibrahim Elzakzaky.
Dis time di group leave di Central District Area and gada for di Banex area around Wuse Zone Two.
But as dem want begin start dia we-no -go gree, na so police begin to shoot to drive dem away.
Di kata-kata make traders wey di sell for di area to run enta dia shop to prevent any stray bullet.
According to eyewitnesses, as di police dey shoot, na so di Zakzaky protest di run enta di Banex plaza wey be di popular business area.