Kidnapping in Nigeria: IGP order security overhaul for South-South, South East highways

IGP Mohammed Adamu

Wia dis foto come from, Nigeria Police Force

Read am in 1 mins

Nigeria Inspector General of Police, Mohammed Adamu don order di total shakeup of security for highways wey dey for di southern part of di kontri.

Di IGP say di police force don perfect plans to begin "Operation Puff Adder" wey be special security arrangement against herdsmen crisis and jaguda pipo wey currently dey go on for Kaduna-Abuja expressway, to now take place for key highways for di southern part of di kontri.

All dis new security development dey com after wetin police describe as "gunmen" kill leader of Afenifere pikin, Funke Olakunrin on Friday along Kajola-Ore road.

IGP Adamu say dis move na part of measures to prevent future occurrence of wetin happun to madam Olakunrin.

Di head of Nigerian Police also assure leader of Yoruba cultural group - Afenifere, Chief Reuben Fasorantin say di police go make sure say dem find di killers of im daughter and go make dem face Wdi full weight of di law."

According to statement wey DCP Frank Mba release, di force don already deploy dia sabi pipo to begin massive manhunt for di killers to bring dem to justice.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di murder of di pikin of di Afenifere leader don raise plent questions about how well di President Muhammadu Buhari goment Dey tackle security palapa across di kontri.

Meanwhile police authorities don arrest two FSARS officers INSPR Sale James, INSPR Monday Uchiola and dia civilian partner and Okechukwu Ogbonna, wey dey operate for Lagos, for acts of professional misconduct like extortion and intimidation of innocent citizens.