Lesley Nneka Arimah: Nigerian writer win 2019 Caine prize for African Writing

Wia dis foto come from, Lesley Nneka Arimah
Nigerian writer, Lesley Nneka Arimah don win di 2019 Caine prize for African Writing.
Arimah short story 'Skinned', wey she publish inside McSweeney's Quarterly Concern (Issue 53) na im give am di award on Monday night.
Di UK born Nigerian writer beat four odas wey dem shortlist for di award to win di annual literature prize.
"I want to say dat we African writers must centre di African focus. We need to dey write to and for each oda, and we also need to play. I think of testing as di sign of pesin wey sabi im work." Arimah tok for her acceptance speech.
Caine Prize wey dem found for year 2000, dem name am afta di late Sir Michael Caine, wey be former Chairman of Booker plc and Chairman of di Booker Prize management committee — di prize dey honour short story of 3,000-10,000 words wey African writer publish in English.
Peter Kimani, wey be di chair of di judges for Caine Prize tok as im dey announce di prize say: "Di winner of dis year Caine Prize for African Writing na unique retake of women's struggle for inclusion inside society wey dey controlled by rituals.
"Lesley Nneka Arimah 'Skinned' change wey pipo know to remove social steps and orders, challenge traditions and envision new possibilities for women of di world." Kimani add.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
President of The Caine Prize Baroness Nicholson of Winterbourne say "Di Caine Prize na light of freedom of speech" "Make di Caine Prize last long!"
End of Di one wey oda users dey read well well
Di announcement of di Caine prize award happun for di award dinner for Senate House, University of London, wey togeda wit SOAS and di Centre for African Studies dem organize.
Who be Lesley Nneka Arimah?
Lesley Nneka Arimah bin grow up for Nigeria plus all di oda different places wey her papa bin work, but na for UK dem born her.
Her story win one National Magazine Award, one Commonwealth Short Story Prize and one O.Henry Award. Her work don appear for New Yorker, Harper's, McSweeney's, GRANTA plus get support from Elizabeth George Foundation and MacDowell, according to di writer official website.

Wia dis foto come from, @CainePrize/Twitter
Dem bin select her for National Book Foundation 5 Under 35 and her first set of work WETIN E MEAN WEN MAN FALL FROM SKY win di 2017 Kirkus Prize, di 2017 New York Public Library Young Lions Fiction Award an dem also select am for di New York Times/PBS book club plus including oda honours.
Arimah na 2019 United States Artists Fellow in Writing. Na 1983 for London dem born Lesley Nneka Arimah.
She day live for Las Vegas and dey work on one novel about you.












