Akwaeke Emezi: American network wan adapt ‘Freshwater’ novel to Hollywood TV series

Wia dis foto come from, Instagram/azemezi
American network FX dey plan to turn Nigerian Writer Akwaeke Emezi book 'Freshwater' into Hollywood television series, according to America Variety.
Emezi go serve as writer and executive producer alongside American filmmaker Tamara P. Carter wey don do work for HBO before.
Di series go focus on Ada wey be Nigerian student for America. She find out say she get three spirits wey dey live inside am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Who be Akwaeke Emezi
Akwaeke Emezi na Nigerian writer and video artist wey grow up for Aba, Abia State, south east Nigeria.
For 2017, Emezi short story, 'Who Is Like God' win di 2017 Commonwealth Short Story Prize for Africa.
Pikin wey dem born for 1987, di 32 years Akwaeke Emezi na lgbo and Tamil writer wey become popular because of her first novel Freshwater.
Freshwater don receive ogbonge awards and na finalist for di NYPL Young Lions Award, the Lambda Literary Award, and the Edmund White Award for Debut Fiction.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Freshwater also carry Best Book of di Year by di New Yorker, NPR, di Chicago Public Library, and Buzzfeed.
End of Di one wey oda users dey read well well
Emezi tok for conversation for Granta say di name na from Igbo proverb wey say, 'All freshwater dey comot from mouth of python.'
For essay wey Akwaeke Emezi write for The Cut, di writer come out as ogbanje and non-binary transgender pesin.
Emezi na di first non-binary transgender pesin wey go dey longlisted for di Women's Prize. Di writer upcoming book Pet, na for teenagers and young pipo.













