Elisha Abbo: Court grant di senator 5 million Naira bail on top accuse of assault

Wia dis foto come from, Senator Elisha
Chief Magistrate Court for Zuba, Abuja Nigeria, don grant bail of 5 million Naira to Senator Elisha Abbo after im plead "not guilty" on two counts of criminal assault charge.
Di police file two counts of criminal use of force and criminal assault charge against oga Abbo wey beat one woman inside CCTV video.
Senator Abbo wey dey represent Adamawa North Senatorial District under di Peoples Democratic Party don already admit say na im dey inside di viral video.
But im don since beg Nigerians and di woman im beat for di CCTV video to forgive am.
Di police decide to file charges against di 41 year old senator after dem chook eye inside di viral video wey comot on June 2.
Before di senator beg on Wednesday, im party di PDP and im leader wey be di party presidential candidate Atiku Abubakar bin frown face for wetin dem see inside di CCTV video.






