Senator Elisha Abbo: Senate, Police go investigate assault case against di lawmaker

Senator Elisha Abbo win election on February 23, 2019 as Senator representing senatorial senatorial district

Wia dis foto come from, Elisha Abbo

Wetin we call dis foto, Senator Elisha Abbo win election as PDP candidate on February 23, 2019 to represent Adamawa North Central Senatorial district
Read am in 2 mins

Nigeria Senate on Wednesday, set up committee to chook eye inside di accuse say Senator Elisha Abbo, beat up one nursing mother for one sex toy shop for Abuja, di kontri capital.

Di seven member committee wey di former governor of Ebonyi State, Sam Egwu, go head go report back to di house in two weeks.

Dis wan dey come as di Nigeria police also tok say dem don launch investigation into di accuse, and dem dey investigate wetin happun between di lawmaker wey dey represent Adamawa central and di woman dat day.

Tok-tok pesin for di force Frank Mba tell BBC Pidgin say di IG, Muhammed Adamu don order very comprehensive investigation into di incident.

"Police don already contact di victim, we don commence investigation, our intention na to make sure say di right tin is done. Our investigation go dey deep, we go look evri-evri, analyse di video, and at di end of di investigation, we go get back to Nigerians and tell dem our findings. na so Mba tok.

Nigerians react afta Premium Times, one online tori pipo publish 10 minutes CCTV video wey dem say involve di 41 year old Senator, wey show as im dey slap and beat one lady inside di shop.

Di senator bin explain give BBC Pidgin wetin happun for di video say di woman bin attack am dat is why e do wetin e do. Di senator bin also accuse say di video no show everything wey happun.

"But I want to say again say dem assault my sista, knock her down, beat her up, so na dat one make me take di action wey I take. Di tin be say one lady attack me beat me up, so I gave her a dose of it." Na so im tok.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Meanwhile, di Presidential candidate of di Peoples Democratic Party for di 2019 elections Atiku Abubakar don join oda notable Nigerians wey don chook mouth for di mata.

Atiku call on di Senator to do public apology, carry imsef go Police, show good example. Im also ask di PDP to take necessary action.