Buhari ADC father-in-law don regain im freedom

Musa Umar with di Police afta dem release am

Wia dis foto come from, Intelligence Response Team

Wetin we call dis foto, Musa Umar with di Police afta dem release am

Kidnappers don release di father-in-law to Nigeria President Muhammadu Buhari aide de camp (ADC).

Kidnappers bin gbab Musa Umar, di Magajin Garin of Daura, for President Buhari hometown for Katsina North West of di kontri for April 2019.

Di IGP Operation Puff Adder Intelligent Response Team join bodi with with police for Kano to carry out di operation for Gangan Ruwa Quarters, Kumbotso LGA Kano State on Monday.

Authorities say dem rescue di Magajin Gari come arrest some suspects with weapons.

Musa Umar with Police afta di rescue

Wia dis foto come from, Intelligence Response Team

Wetin we call dis foto, Musa Umar with Police afta di rescue
Musa Umar with Police afta im free

Wia dis foto come from, Intelligence Response Team

Wetin we call dis foto, Musa Umar with Police afta im free