Radio Bayelsa shut down afta early morning fire outbreak

Radio Bayelsa don shut down afta early morning fire burn some parts of di station for south-south Nigeria.

Chairman of di Nigerian Union of Journalists (NUJ) for di state Samuel Numonengi confam to BBC Pidgin say di fire wey start from di transmitter room spread enta di studio, destroy tins dia.

According to am, na cleaner wey come work na im see di fire raise alarm before Fire Service come start to dey quench di fire.

Commissioner for Information of di state Daniel Iworiso-Markson tell BBC Pidgin say di fire affect di lve studio, recording studio and di accounts department.

Di commissioner add say gofment don set up investigative panel to find out wetin cause di fire.

Nobody die for di incident.