You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
9th National Assembly: Danjuma Goje don step down for Ahmed Lawan to eye Senate President
Senator Danjuma Goje don step down for Senator Ahmed lawal as di candidate wey Nigeria goment party APC go use contest for di next Senate President.
Goje step down afta dem do meeting wit President Buhari for Aso Rock on Thursday afternoon, according to Ahmad Bashir wey be presidential assistant to Muhammadu Buhari.
Na for March 2019 di All Progressive Congress announce say e don adopt senator Ahmed Lawan as senate president for di ninth Assembly.
During Thursday meeting na Govnor Nasir Ahmad Elrufai of Kaduna, Senate Leader, Ahmed Lawan, Senator Ahmed Goje and Senator-elect, Uba Sani wit President Muhammadu Buhari na im dey for di meeting for State House.