You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
NNPC recruitment tie-wrapper as about 60,000 pipo wey write dia job exam
Read am in 1 mins
Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) say at least 60,000 candidates write dia computer test to fit get work wit di company.
Isaiah Inuwa, wey be di oga patapata for di company, say di Saturday exam happun for about 94 centers for 22 states across di kontri.
Im say NNPC colobi wit some institutions, to make sure say di thing go well.
Di company say dem wan employ to replace some of dia staff wey dey retire, and to refresh di system wit fresh hands.
E no dey clear how many pipo di company wan employ, for dis recruitment.