Asamoah Gyan: Black Stars captain don return from retirement after Ghana President intervene

Wia dis foto come from, ASAMOAH GYAN
Black Stars striker, Asamoah Gyan reverse en decision to retire from Ghana national team 48 hours after he announce en exit.
En decision to return be after Ghana President Nana Akufo-Addo talk am sey make he consider de national interest den return to de team.
Gyan decide sey he go retire sake of captaincy issues he get plus Black Stars Coach, Kwesi Appiah, who wan appoint a new captain for de 2019 AFCON tournament.
For press statement inside, Gyan talk sey: "I take de request of His Excellency Nana Addo Dankwa Akufo-Addo in good faith, so ah go make myself make Kwesi Appiah select me."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
President Akufo-Addo talk plus Gyan on Tuesday for phone interview inside wey he con am sey make he consider "national interest" den make en body available so sey Coach Kwesi Appiah fit select am.
Asamoah Gyan confirm en conversation plus de president dis morning wey he tweet sey en team go communicate decision give Ghanaians today.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
According to Gyan, presidential request be something he no fit disregard sake of that he go support de national team so sey dem go win de 2019 AFCON trophy.
Ghana win de AFCON trophy four times, de last time dem win be in 1982.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ghana's President also talk plus de Black Stars coach, Minister for Youth and Sports, de President of the GFA Normalisation Committee over Gyan en decision to quit de national team over captaincy issues.
As Ghana's all-time leading goal-scorer, sports enthusiasts sey he get major role to play give Ghana for de upcoming 2019 Africa Cup of Nations.














