Nigeria Airport workers strike: Aviation unions cari dia action block NCAA office

Dis na some photo of di strike action
    • Author, Gift Andrew
    • Role, Reporter, BBC News Pidgin, Lagos

Nigeria Airport workers wey begin strike on Wednesday until further notice, cari protest go block office di headquarters of Nigeria Civil Aviation Authority - NCAA.

Di workers dey demand beta working conditions and say make goment inaugurate di board of Nigeria Civil Aviation Authority plus oda tins.

Di striking unions say goment no meet dia demands upon say dem bin don give goment seven days notice.

Dis na some photo of di strike action;

Nigeria Airport workers block NCAA office
Dis na some photo of di strike action
Aviation workers for Nigeria begin strike on Wednesday till further notice sake of say goment no meet dia demands upon say dem bin don give goment seven days notice.
Lagos Airport

Musa Drisu, di current Chairman of National Union of Air Transport Employees NUATE for Lagos tell BBC Pidgin on Wednesday morning say dia members no go work till goment come answer dem.

Departure lounge for Lagos Airport
Wetin we call dis foto, Departure lounge for Lagos Airport

Dis mata so fit affect flight operations sake of say workers no go dey to help arrange how tins go take waka for di airports.

Officials say dem no go stop any plane from flying.

'Di workers dey demand beta conditions of work, say make federal goment inaugurate NCAA board plus make dem implement di workers organogram wey di workers and goment bin agree on.' Aviation union leader for Lagos comrade Lucky Izevbokun tok.

Di unions wey join hand dey go strike include National Union of Air Transport Employees (NUATE), Air Transport Services Senior Staff Association of Nigeria (ATSSSAN), Association of Nigeria Aviation Professionals (ANAP) and National Association of Air Transport Pilots and Employees (NAAPE).

Wetin we call dis Video, Meet di security men wey return bag wey money full inside