Naira Marley, Zlatan Ibile and odas still dey awa hand for yahoo-yahoo - EFCC

Naira Marley et al

Wia dis foto come from, EFCC

Wetin we call dis foto, Zlatan Ibile wey wear red and Naira Marley wey dey third from left, na rising musicians for Nigeria
    • Author, Princess Igho Williams
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
  • Read am in 2 mins

Nigeria anti-corruption police say popular Nigerian musicians Naira Marleya and Zlatan Ibile and three odas, still dey dia hand onto accuse of yahoo-yahoo.

Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say di singers still dey dia custody and dem arrest dem in relations to internet fraud operations.

Videos dey fly upandan for social media, say di musician don free, but EFCC confam to BBC Pidgin say dat wan na lie.

"EFCC arrest Afeez Fashola (aka Naira Marley) and Omoniyi Temidayo Raphael (aka Zlatan), in connection wit accuse of internet magomago wey also link dem to cybercrime offences.

"Naira Marley dey our custody as we speak and e dey give very useful informate to our investigators. Im arrest get to do wit im involvement wit internet fraud (Yahoo-yahoo operations)." EFCC Acting tok-tok pesin, Tony Orilade confam give BBC Pidgin.

Naira Marley

Wia dis foto come from, NAira Marley

Wetin we call dis foto, Naira Marley

"You know say we don dey clamp down on di activities of yahoo-yahoo boys, if you don dey follow up our activities in recent times."

EFCC give di names of di oda pipo dem arrest wit dem as Tiamiu Abdulrahman Kayode, Adewunmi Adeyanju Moses and Abubakar Musa.

Dem say na for early mor-mor of Friday dem arrest dem for Gbangbola Street, Ikate, Lekki, Lagos and say dem see dem wit some items wey include laptops.

Recently, Naira Marley cause some argument for social media wit some of im statement wey dey glorify Yahoo boys.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

E don see popular songs like 'Issa Goal' and im recently release di official video of im hit track, 'Am I A Yahoo Boy' featuring Zlatan on Thursday.

Many Nigerians and foreigners don fall victims of yahoo boys wey use trick collect dia money.

For Nigeria, section 419 of di kontri criminal code tok say 'any pesin wey by any false pretence, and wit plan to defraud, obtain from any oda pesin anytin wey dey capable for pesin to tiff, or make any oda pesin to deliver to any pesin anytin wey dey capable for pesin to tiff, dey guilty of felony, and fit go prison for three years.'

Wetin we call dis Video, Port Harcourt comedian Newmanny explain why im naked for Nyesom Wike