Abuja raid: Amnesty International say to harass women dey unlawful

Wia dis foto come from, Getty Images
Ogbonge international human rights pipo Amnesty International don chook mouth ontop how authorities for Nigeria take arrest and shame women wey wear skimpy clothes.
Di group enta social media to tok say to dey harass women dey unlawful and e dey violet dia human rights.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Amnesty tell Nigeria police and Federal Capital Territory Authorities to stop to dey harass women sake of say wetin dem dey do na gender discrimination.
Nigerian Police bin don respond to di I no go gree protest wey happun on Saturday for di kontri capital Abuja ontop how authorities dem arrest and shame women wey wear skimpy clothes.
Usman Umar wey be FCT police commissioner ontop operations say dem go sidon wit Abuja Environmental Protection Board to really understand why dem dey arrest women.
"We don begin do investigate ontop di mata, we go gbab and punish pipo wey do dis bad tin" na so Usman tok.

Some Human Rights Activist dem para enta major streets for Abuja to do I no go gree on Saturday sake of di women arrest mata.
Di protesters wey wear black cloth start dia waka from Old Parade ground for Abuja go di FCT police command.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di protesters carry placard wit different words like " I be woman and di way I dress na my choice."
Someof di girls wey task force arrest accuse dem say some police officers rape dem wen dem dey detention.

Wia dis foto come from, BBC
For di activists di arrest dem dey unlawful, say dem tamper on di rights of di women dem.

One of di pipo wey come out na women rights activist Aisha Yesufu, she say di reason she come out na to say enough is enough.

"E come be like say because we be women na crime e be, dem just dey treat women anyhow, you go dey waka even for afternoon, police go carry you put you for car, we kan dey hear say di pipo wey dem carry, police go rape dem before dem free dem. Na so Aisha tok.

Anoda woman wey join di protest say "Di mata don tire us, wetin dey happun to women for Naija e no good, we want say make dis change, make police protect us.
"We no fit move, we no fit breathe, we no fit wear cloth, we no fit go club, police wey suppose protect us na dem dey rape us, we want make Nigerians know say women's right na human right we no different for anybody wey dey street." Na so she tok.













