Book reviewer Tamara Ebitonmor na 11-year-old wey don read pass 400 books

Wetin we call dis Video, Book reviewer Tamara Ebitonmor na 11 years old wey don read pass 400 books

As part of activity to mark dis year World Book Day, BBC Pidgin siddon with 11-year-old Tamara Ebitonmor wey be ogbonge book lover and book reviewer.

Tamara no dey only review books, she dey also read to children like herself.

Tamara and her sisters, Ebineme (8years) and Tonye (5years) wan use dia tori encourage oda pikin dem to dey read book around di world.

Video Journalists: Sarah Tiamiyu and Faith Ilevbare