#justiceforstephen: Lagos police don gbab two suspect on di killing of Dr Stephen Urueye

    • Author, Gift Andrew
    • Role, Reporter, BBC News Pidgin, Lagos

Police for Lagos state Nigeria say dem done gbab two suspects in connection to di stabbing and killing of one medical doctor for Lagos University Teaching Hospital LUTH.

Di tok tok pesin Bala Elkana tell BBC Pidgin say dem dey investigate di case.

Dr Stephen Urueye wey be student medical doctor wey dey work wit Lagos University Teaching Hospital (LUTH), die for hospital a day afta some bad pipo stab am near LUTH.

Di Police PRO say di doctor dey out wit im friends on Thursday night before arm robbers attack am along di lagoon. Dem snatch im valuable items come injure am.

Im fellow doctors and student doctors enta road to protest di killing and to ask goment to give dem beta security for the area as dis no be the first time jaguda pipo dey attack doctors dia.

Dr Ureya wey study medicine and surgery die two days afta im attend im convocation ceremony.