Omar al-Bashir: Nigeria say make Sudan restore constitutional order as military seize power from President al-Bashir

Sudan's President Omar al-Bashir poses for a group photo with members of his new 20-member cabinet as they take oath at the presidential palace

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Make Sudan restore constitutional order - Nigeria
Read am in 2 mins

Nigeria goment don react to wetin dey happun for Sudan, as military seize power from President Omar al-Bashir.

Geoffrey Onyeama wey be Foreign Minister say Nigeria dey hope say violence no go happun.

"Our priority be say make violence no happun, and e dey very important say di constitution and constitutional order still get respect and dem restore di order as quickly as possible" Onyeama tell BBC Pidgin.

Meanwhile Sudan Professionals Association say wetin di defence minister announce na coup wey dem no go accept as e be say na di same pipo from President Omar al-Bashir goment .

Sudan military on Thursday afternoon say dem don seize power, arrest President Omar al-Bashir afta nearly 30 years wey im dey power.

Omar al-Bashir - 5 April

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Na since 1989 oga Omar al-Bashir use coup collect power from one civilian goment inside di kontri.

Di kontri Defence Minister Awad Mohamed Ahmed Ibn Ouf wey give di announcement for national TV say dem go arrest President Bashir "inside a safe place".

Di defence minister say dem go set transitional military council for two years and dem go release all political prisoners.

For di announcement, oga Awal say di kontri go maintain diplomatic relationships with oda kontris.

Na since 1989 oga Omar al-Bashir use coup collect power from one civilian goment inside di kontri.

Wetin we call dis Video, Di military also three months state of emergency, according to di Defence Minister Awad Mohamed Ahmed Ibn Auf

Di announcement 'main protest group don reject am'

Di group wey dey lead di protests against President Omar al-Bashir reject di defence minister statement, Reuters news agency tori pipo dey report, according to tori from Sudanese Professionals Association.

Di association call on pipo to remain for di we no go gree waka outside di military headquarters for di capital, Khartoum, according to di tori.

Before di announcement , thousands of residents for di Sudan capital city of Khartoum begin chant say dia leader Omar al-Bashir regime "don fall."

President Omar al-Bashir inside white cloth dey waka comot afta im vote for 2015

Wia dis foto come from, Anadolu Agency

Wetin we call dis foto, President Omar al-Bashir inside white cloth dey waka comot afta im vote for 2015

Reuters news agency dey quote unnamed sources say di president don step down and consultation dey under way to set up transitional council, but we never fit confirm di tori.

Before di announcement , thousands of residents for di Sudan capital city of Khartoum begin chant say dia leader Omar al-Bashir regime "don fall."

Reuters news agency dey quote unnamed sources say di president don step down and consultation dey under way to set up transitional council, but we never fit confirm di tori.

Di protesters say dem "dem no go comot from here, we dey wait for di big news. But we know say Bashir must go."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

According to eye witness dem wey tok to Reuters and AFP, some Sudanese soldiers raid di office of one group wey dey linked to di President ruling National Congress for Khartoum.

President Bashir don dey for power since 1989 wey be 30 years now.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2