Omar al-Bashir: Sudan dey wait as rumour say coup don happun dey fly upandan

Wia dis foto come from, Reuters
Thousands of residents for di Sudan capital city of Khartoum don begin chant say dia leader Omar al-Bashir regime "don fall."
Dem still dey wait for statement from di army wey dem promise more than four hours ago.
Reuters news agency dey quote unnamed sources say di president don step down and consultation dey under way to set up transitional council, but we never fit confirm di tori.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di protesters say dem "dem no go comot from here, we dey wait for di big news. But we know say Bashir must go."
According to eye witness dem wey tok to Reuters and AFP, some Sudanese soldiers raid di office of one group wey dey linked to di President ruling National Congress for Khartoum.
President Bashir don dey for power since 1989 wey be 30 years now.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2








