Brunei gay sex: Homos, supes go die by stoning - Goment new law

Strong Islamic law wey Brunei introduce on Wednesday for anybodi wey do gay sex and adultery to face death by stoning as punishment, na im don spark international reaction and condemnation from members of LGBT community .

Dis new law wey take effect from 4 April, 2019 go also cover oda crimes wey include amputation for pipo wey tiff.

Nigerian gay rights activist Bisi Alimi for interview with BBC Pidgin tok say "di law no go well as to be gay no be crime."

Im say "di law get as e be as pipo wey dey part of di community na pipo brothers, sisters and pikin."

Brunei gay community express shock and fear for wetin dem call "old school punishment."

Before now, Homosexuality dey illegal for Brunei and e dey punishable by upto 10years for prison.

Many African kontris including Nigeria, Uganda, Ghana and Cameroon get laws wey make am criminal offence to be gay, lesbian, bisexual and transgender.

Call for boycott of Brunei hotels

Hollywood actor George Clooney don tok say make pipo no patronise di nine luxury hotels wey Brunei own.

Oga Clooney comments dey come afta Brunei say dem go stone anybody wey dey do gay sex to death.

For am, di new laws dey "violate human rights."

Meanwhile one university tok tok pesin don tok say make King's College London collect bak dia honorary doctorate degree wey dem give di Sultan of Brunei, Hassanal Bolkiah.

Fi Fellowships and Honorary Degrees Committee say dem go review di degree wey dem give Sultan Bolkiah for 2011.

Brunei, dey on island of Borneo, and na Sultan Hassanal Bolkiah dey rule am. Di small kontri dey rich on oil and gas exports.