You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kenya don burn thousands of condoms wey fail test
Read am in 1 mins
Authorities for Kenya don destroy $100,000-worth of Fiesta condoms, di Pharmacy and Poisons Board announce for Twitter.
Dem say dis wan na afta di condoms fail quality tests.
Last year, di health ministry bin recall Fiesta Stamina and Fiesta Big Black condoms say dem no meet quality.
"Di batch for Fiesta Stamina fail freedom from holes test while dat for Fiesta Big Black fail thickness test," one statement wey Citizen TV quote, tok for November.
Last year, one man Williamson Omworo bin sue one condom company afta e burst as im dey use am.