Nigeria Elections 2019: PDP leaders carry protest go INEC Headquarters for Abuja

PDP leaders dey march go INEC HQ

Wia dis foto come from, Twitter/@OfficialPDPNig

Wetin we call dis foto, PDP leaders dey march go INEC HQ
Read am in 2 mins

Di national leadership of di opposition party for Nigeria, Peoples Democratic Party, don carry protest go di headquarters of di Independent National Electoral Commission office for Abuja.

Di national chairman of PDP Uche Secondus lead di protest wit some oda pipo wey carry placard dey shout return our mandate.

Di PDP presidential candidate Atiku Abubakar reject di result of di February 23 election say dem dey go court.

PDP tok-tok pesin Kola Ologbodiyan say dem get intelligence say federal goment wan send military go Delta, Rivers and Akwa-Ibom states to rig di election dats why dem cari I-no go gree go INEC office.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

PDP protest for INEC HQ
Pipo dey do I no go gree
Wetin we call dis foto, Pipo dey do I no go gree

Kola say for di presidential election, di role of di military no clear as di party shock

say goment use back door deploy soldier go do mago-mago for some states." Supreme Court bin don give order say make military no participate for dis election but di president and im party APC pass backyard use soldier on top pipo for Rivers state wey lead to death of pipo."

Na so Kola tok.

INEC tok-tok pesin Aliyu Bello respond say di commission go chook eye for di PDP leaders dem complain,

say di commission go make sure say dem dey transparent and ensure free, fair and credible election

for di governorship election.