Olusegun Obasanjo: "Atiku beta pass Buhari two times"

Wetin we call dis Video, Nigeria 2019 Elections: Why I forgive Atiku - Olusegun Obasanjo

Former president Olusegun Obasanjo don tok say as far as im dey concern Nigeria main opposition presidential candidate Atiku Abubakar dey two times beta than current President Muhammadu Buhari.

Obasanjo for special interview wey im sidon alone yan wit BBC say if pipo sabi di kain corruption wey dey happun under Buhari goment, e worst pass, in fact pipo wey dey commit inside im goment no go just go jail, dem go catch fire.

"Evritin about Buhari, I believe say Atiku beta pass Buhari times two"

Oga OBJ also explain give why im decide to forgive Atiku ahead of di 16 February general elections for Nigeria.

"So if APC bring Buhari and PDP bring Atiku and from wetin I sabi about Buhari... and wetin im don do e show say im no sabi di work, e dey do partial, im dey evil and dey do anyhow even for corruption."

'Di choice we get for Nigeria situation today and I dey tok about 2019 na betwwen di candidates of APC party and di candidate of PDP party di odas na minor-minor party wey go line behind dem' - Obasanjo tok.

Already President Muhammadu Buhari on Monday come out say na jealousy dey worry Obasanjo.

Nigeria goment say di 16-page letter wey former president Olusegun Obasanjo write show say im mind dey confused and e need doctors quick -quick to treat am.