Nathan Alexander: American lecturer don collect accolades on top say e collect one pikin from im student papa

Wia dis foto come from, Twitter/@Original_Vaughn
One US maths professor picture don go viral afta e bin help im student cari small pikin for class.
Na her papa Wayne Hayer, cari baby Assata enta class as e bin no fit find babysitter for di pikin.
According to Professor Nathan Alexander, oga Haye na papa wey get two jobs, na full time student and also dey attend leadership programmes.
Na di teacher ask oga Hayes to bring di pikin come school afta e notice say di student no dey stay to di end of class so e go fit take care of im pikin.
Oga Alexander tok say e bin dey fear say she go cry disturb class, but say "she dey very well behaved and e go well-well."
Alexander dey Morehouse college, wey be all male college for Atlanta, Georgia. Di school na di place wia Dr Martin Luther King for finish school.
Accolades don dey flow like water for di professor.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Pipo also follow praise di Pikin papa.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Even as odas start to dey tok di tori about hoe dia own teachers don help dia pikin for schol.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
For Facebook post, Assata mama, Firda Hayer, thank Oga Alexander for im help and pipo for social media for di beta tins wey dem tok
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post










