Eli Waduba drawing of Kevin Hart dey make artist redouble dia hustle for social media?

Read am in 2 mins

Na normal day just dey waka pass wen tori land say Kaduna based Eli Waduba wey be Nigerian hyperrealist don meet di eye of American comedian Kevin Hart wey wan buy im artwork.

So, pipo for social media don redouble dia hustle on top di platform.

Plenti of dem use biro for dia works while odas use pencil, all dey waka enta social media to post.

Dis artist wey call imself Hypertension artist use one stone kill two birds afta e draw American music producer, DJ Khaled and rapper Jaden Smith.

Dis oga throw im own shot far to reach Freaky Friday musician Chris Brown.

Migos Star and rapper plus Cardi B husband, Offset follow for di target wey dem dey shoot.

Dis oga want make Nigerian singer, Wizkid for see im work.

Plus dis one wey dey halla for pipo to help am so dat Burna Boy go chook eye for im hustle.

Anoda artist also enta di mata wit drawing of Davido.

E plenti sotay Nigeria artist Peruzzi follow ansa one artist wey draw picture of am afta she lose control on top im gbedu.

No be today pipo don try to dey sell market for on top social media oh. In fact, early last year, some creative pipo gada to sell market with di #WeAreNigerianCreatives hashtag.

Popular 10 year old Nigerian hyperrealism artist Karim Waris even blow for May 2018 wey BBC News Pidgin display im talent.