Canada: So you wan port from Nigeria, how long e go take?

Canadian Flag

Wia dis foto come from, Tony Savino

Wetin we call dis foto, Di Senate pass di bill, with 52 votes in favour and 29 against

Over 250,000 Nigerians enta Twitter on Saurday to tok about dia plans to japa go Canada.

Na part of di vex wey Nigerians dey vex afta dem wake up to hear say say di Independent National Electoral Commission postpone di elections wey suppose hold on Saturday 16 February go 23 February 2019.

To waka

  • E go take you about 2 months and 1 week to waka from Lagos to Toronto (Canada)
  • E go take you about 3 months and 4 weeks to waka from Lagos to Syndey (Australia)
  • E go take you about 2 months and 1 week to waka from Lagos to New York (US)
  • E go take you about 1 month and 2 weeks to waka from Lagos to London (UK)
  • E go take you about 3 months to waka from Lagos to Beijing (China)
  • E go take you about 1 month and 2 weeks to waka from Lagos to Berlin (Germany)


To enta bus

  • E go take you about 3 days and 21 hours to take bus from Lagos to Toronto (Canada)
  • E go take you about 6 days and 16 hours to take bus from Lagos to Syndey (Australia)
  • E go take you about 3 days and 16 hours to take bus from Lagos to New York (US)
  • E go take you about 2 days and 8 hours to take bus from Lagos to London (UK)
  • E go take you about 5 days and 7 hours to take bus from Lagos to Beijing (China)
  • E go take you about 2 days and 10 hours to take bus from Lagos to Berlin (Germany)


To fly

  • E go take you about 11 hours and 19 minutes to fly from Lagos to Toronto (Canada)
  • E go take you about 19 hours and 26 minutes to fly from Lagos to Syndey (Australia)
  • E go take you about 10 hours and 41 minutes to fly from Lagos to New York (US)
  • E go take you about 6 hours and 46 minutes to fly from Lagos to London (UK)
  • E go take you about 15 hours and 28 minutes to fly from Lagos to Beijing (China)
  • E go take you about 7 hours and 1 minute to fly from Lagos to Berlin (Germany)


#BBCNigeria2019