Na here we go march break!
Remember say INEC chairman Prof. Yakubu Mahmood say no political party dey allowed to do campaigns until 23rd February election.
Until we show again for di postpone election.
Una bye-bye!

INEC don talk say on top some logistics things, presidential and national assembly elections for Nigeria go hold for February 23 and Governorship election go hold for March 9.
Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo
Remember say INEC chairman Prof. Yakubu Mahmood say no political party dey allowed to do campaigns until 23rd February election.
Until we show again for di postpone election.
Una bye-bye!

Nigerian Nollywood actor, Ime Bishop Umoh aka Okon Lagos na one of di INEC Observers wey suppose monitor Saturday election wey di kontri election office don postpone to 23rd February, 2019.
Okon Lagos wey dey represent National Institute for Legislative and Democratic Studies say as tins be so im dey monitor di election postponement.
Jaguda pipo don burn down six buses wey carry INEC materials for Obot Akara Local Government Area for Akwa Ibom state, South-South Nigeria
Tori be say two pipo die for di incident.
Edet Akpan wey witness di incident tell BBC News Pidgin say na for early mor mor Saturday di tin happun.
Im say corpers bin follow dey inside di motor wen di tin happun but im no know weda dem follow for di two pipo wey die.
Wen BBC pidgin speak with Akwa Ibom state police tok tok pesin, Odiko Macdon im say both him and di Commissioner of Police dey on dia way to di scene and dem go only tok wen dem see wetin don happun.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
INEC chairman Prof. Yakubu Mahmood say no political party dey allowed to do campaigns until 23rd February election.
Di head of Nigeria election office give key stakeholders dis warning on Saturday as im dey ansa kwesions ontop reasons whyINEC postpone election.
E add say e no more collection of Permanent Voters Cards -PVCs until afta di elections.
Di election wey dem shift from Saturday 16 February, go now hold on Saturday 23rd February 2019.

Wia dis foto come from, INEC
Head of Nigeria election office, Yakubu Mahmood and members of di Independent National Electoral Commission tell key stakeholders say na fire, bad weather, delay for transport of ballot papers and result sheets make dem postpone di 2019 general elections.
"E no get anytin to do wit security or influence"
Prof. Mahmood say im dey very very sorry for shifting di date of di election from 16 Feb. to 23 Feb. 2018 and say im take 'responsibility' for di postponement.
E say dem face sabotage wen INEC office dem catch fire for Abia, Anambara and Plateau state but dem try overcome am.
Again, dem face delay for transport of election materials from Central Bank of Nigeria and in some case bad weather delay flight.wey cari election material just 24 hour before di election.

Wia dis foto come from, INEC
President Muhammadu Buhari don waka comot from im village for Daura, Katsina state.
Buhari wey be di APC candidate reach Abuja dis afternoon afta INEC Postpone today Presidential and National Assembly elections.

Wia dis foto come from, Femi Adesina

Wia dis foto come from, Femi Adesina

Wia dis foto come from, Femi Adesina

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigerians still dey para afta di midnight postponement of di 2019 General Election.
As political parties dey blame each oda and Nigerians dey shame for di process, INEC don put simply say na logistics make di election date bend.
But wetin fit be dis logistics? Dis na some ideas:
Presidential candidate of di People's Democratic Party, Atiku Abubakar don describe di postponement of di 2019 general elections as "hand of Esau, voice of Jacob."
Di PDP candidate wey say na Buhari postpone di election, say na to provoke Nigerians to do something bad wey di goment go use do more-more "anti-democratic" things.
"I call on all Nigerians to dey patient. We don tolerate di bad things wey dis goment do for four years. We go fit extend our tolerance few more days and use vote tell dem our mind," im tok for im twitter page.
Im add say dem fit postpone election but dem no fit postpone destiny.

Wia dis foto come from, Atiku
Presidential candidate of di African Action Congress (AAC) Omoyele Sowore don follow BBC Pidgin tok about di election postponement.
Im say e no make sense say election wey dem plan for four years, dem use 6 hours postpone am.
"Na so dem do for 2015...but di thing wey we dey tell dem be say weda dem postpone or no postpone election, na we go still win dis election," im tok.
Im tell im supporters say make dem no worry, make dem still come out to vote next week.

Wia dis foto come from, Bayo Omobowiowo
President Muhammadu Buhari don chook mouth ontop di postponement of Saturday election by INEC.
Di presido wey be one of those wey dey follow contest, say INEC no try at all and e dey disappointed like many Nigerians say dem postpone afta all di support wey im goment give dem.
Di Presido wey say e dey leave Daura, Katsina northwest Nigeria dis morning to attend stakeholders meeting with INEC by 2pm Nigerian time add say make di election bodi make sure say materials wey don already dey location dey safe for next week.
Earlier we bin show foto wey look like Port Harcourt still dey sleep. Di pipo don wake up and wetin follow am na traffic.

BBC Pidgin bin dey live for Facebook wia our reporters wey dey ground for different parts of di kontri give us tori of wetin dey happun.
You fit watch di video here or for our Facebook page.
By 10am Nigerian time, we go dey Live again to bring you more tori.
Pishures full ground of members of National Youth Service Corps (NYSC) wey be di pipo INEC dey use as polling officers for Nigeria elections.
INEC don postpone di election but many of di corpers wey be adhoc staff bin don already deploy across Nigeria.
Tori wey don dey go round social media show corpers dey sleep for field and public buss for different places.

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter

Hajiya Sa’adatu bin neva hear say dem don postpone election and she come out to vote. She say bodi no sweet her as she bin wan be di first to vote for Kano State.

Many Nigerians wey bin don prepare to vote on Saturday, dey provoke give INEC and di chairmo Prof. Mahmood Yakubu afta dem postpone election by one week.
Na ontop social media many of dem gada to pour out dia vex.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4