Nigeria Elections 2019: How INEC offices dey ready for Saturday election

BBC go dey for all di 36 states inside Nigeria and di capital Abuja to bring you all di latest for Saturday election.

Policemen
Wetin we call dis foto, For di INEC office wey dey Yaba, Lagos state, policemen full ground to make sure say 'shaking' no dey. Dem pose for dia evening parade on Wednesday.
Inec materials
Wetin we call dis foto, Sensitive and non-sensitive materials don land for Lagos on Wednesday, ahead of di election.
Bayelsa inec
Wetin we call dis foto, INEC office for Yenegoa, Bayelsa State, southern Nigeria dey like playground for school pikin dem, but na sorting dem dey do.
Inec card readers
Wetin we call dis foto, INEC engineers dey work hard for dia Lagos office, to arrange di card readers for Saturday election.
Inec materials
Wetin we call dis foto, Dis no be Valentine gift, na card readers wey still dey inside pack for Saturday election.
Inec materials
Wetin we call dis foto, Wetin be Lagos own, don enta Lagos. Dis man ontop still need to make sure sha.
Inec materials
Wetin we call dis foto, Dis na wetin di card readers look like, wen dem no dey inside carton.
Inec materials
Wetin we call dis foto, Say cheese! No be for dis INEC engineer wey dey work very hard ontop card reader.
Inec fire

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, On Tuesday for Awka, Anambra State for southeast, fire bin burn card readers wey pass 4000 for INEC office, but dem say no shaking, election go still happun.
Airforce

Wia dis foto come from, NAF

Wetin we call dis foto, Nigeria Airforce also join hand, help INEC transport dia materials to different parts of di kontri.