Presido Buhari no dey correct.
Di federal goment bin true-true start for di road to invest heavily for agriculture for dia Economic Recovery and Growth Plan 2017-2020
Di aim na to make Nigeria fit provide imself with di rice dem need by 2018 and for wheat production for 2020. But, dem no fit fulfill di rice promise by di end of last year and e no look like dem go meet di deadline for wheat.
Although rice production for Nigeria don dey increase small-small ova di last five years, and di numbers show say e go increase for 2019, di kontri still be one of di largest importers of rice for world.
For 2014, di average price per metric tonne for rice bin dey at US$425. Dat time, Nigeria bin dey import 2,600,000 metric tonnes of rice, wey cost reach $3,027,400. Dis na estimate of $3 million per day and we neva even add tax and tariff for di mata.
For 2018, di price for rice neva too change too much. Di current average consumer price for rice na around $421 per metric tonne. Even though Nigeria don reduce improtation, at di rate of 2,400,000 metric tonnes of rice wey dem import for 2018, Nigeria fit still don spend $2,766,027.40 or $2.7 million per day.
Di demand for rice dey increase as di population dey grow. Nigerians neva dump dem love for jollof.
Food na big wahala for Nigeria and di palava for di North East and Middle Belt don dey affect wetin crops dey produce and for family, dia way to make moni wey fit last.
According to Global Hunger Index (GHI), Nigeria na number 103 out of 119 kontris for di level of hunger and dem see am as "serious" wahala.
For March 2018, Presido Buhari launch di National Food Security Council, task team wey e dey lead, to face di mata of food insecurity for Nigeria.