Grammy 2019: Childish Gambino win song of di year, Lady Gaga get three, Cardi B make history

Lady Gaga

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lady Gaga also win best pop vocal for Joanne
Read am in 2 mins

Childish Gambino 'THIS IS AMERICA' win di song of di year for di 61st Grammy Awards wey happun until early hours of Monday.

THIS IS AMERICA become di first American rap song to win dat category.

Although Gambino bin no show face, im also collect three awards like Best Rap song performance award.

All togeda di American rapper wey no show face for di award ceremony bin win Record of di year, song of di year, best music video and Best Rap/Sung performance.

Lady Gaga become early winner for di 2019 Grammys to pick up three prizes, including best pop duet for Shallow.

As she try to stop her cry, di star thank Bradley Cooper, her co-star and director inside A Star Is Born, wey miss di show to attend The Baftas.

She use her speech to tok about di importance of di mental health message inside her video, telling di audience say: "If you see someone wey dey feel hurt, no look away."

Ariana Grande, Dua Lipa and Childish Gambino cari major awards go house.

Dua win best new artist - wey be one of di four main awards inside di night- e become di first British artist to receive di honour since Sam Smith for 2015.

She thank "all di incredible female artistes" she collect nomination wit, come add say; "I guess dis year we don really step up."

Dua Lipa

Wia dis foto come from, Getty Images

Ariana, wey bin pull out of di performance she bin plan afta she get small quarrel wit di organisers, receive best pop album for Sweetener - wey be her first ever Grammy Award.

"Dis dey wild and beautiful," Na so she tweet. "Thank you wella."

Brooklyn rapper Cardi B become di first solo female to win best rap album, for her debut Invasion of Privacy.

She too thank her newborn daughter Kulture Kiari for giving her di strength to finish di record on time.

Wetin happun to Seun Kuti of Nigeria?

Seun Kuti

Wia dis foto come from, Getty Images

Afrobeats musician Seun Anikulapo Kuti no win di award dem nominate am for inside di ogbonge 2019 Grammy awards for America.

Kuti di son of music legend Fela and im band Egypt 80 collect di nomination for dia 'Black Times' album for di World Music category inside di 61st Grammy Awards but di 36 year old and son of late Fela Anikulapo Kuti lost to South Africa Soweto Gospel Choir wey grab their third Grammy Awards for di album ''Freedom'', inside Category category wey artistes like Bombino from Niger, Mali's Fatoumata Diawara and Soviet Yiddish Glory bin contest.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post