Vice Presidential Debate: How health sector go be from 2019 #ThePeoplesDebate

Nurse dey give pesin wey sick cough melecine

Wia dis foto come from, @Fmohnigeria/Twitter

Vice presidential candidates wey show for Thursday debate wey BBC Africa do wit TVC Nigeria and Enough is Enough Nigeria don chook mouth on top how to improve Nigeria health sectors

Dem say pesin no suppose wait till e sick before e go go see doctor, but say na wetin dey happun for Nigeria sake poor health wey dey di kontri.

"As health workers dey leave Nigeria waka go oda kontris, e dey weak our health system" dat na wey Ahmed Rufai of African Action Congress tok for di vice presidential debate.

E say "we go employ 160,000 health personnel to work for di 774 local goment for di kontri".

Vice Presidential candidate for debate wey BBC Africa package

'We go use ten percent of Nigeria budget to improve health sector'

Di vice presidential candidate of Alliance for New Nigeria Khadijah Abdulahi say one of di best ways to improve di Nigeria health sector na to allocate ten percent of di kontri budget to di health sector.

Khadijah Abdulahi

Khadija Abdulahi of Alliance for New Nigeria say dem go put ten percent for Nigeria budget to health sector.

She also say dem go sensitise doctors and oda health personnel to treat pipo for community.

"We go make sure that all Nigeria get National Insurance" na so she tok.

She say "we go equip di health facilities and dis go cut down infant mortality rate".

'Omoyole Sowore for be palm wine tapper if no be for education'

The Peoples Debate

Wia dis foto come from, Other

Vice Presidential candidate of di African Action Congress Rabiu Ahmed say im running mate, Presidential candidate of im party, Omoyole Sowore for be palm wine tapper for Ondo State if no be for Education.

Ahmed tok dis one as e dey ansa qweshion ontop dia party policy for Education during di Peoples Debate wey happun for Abuja, Nigeria capital on Thursday.

According to Rabiu, over di years, different goment don refuse to address all di nyama-nyama wey dey happun for di education sector and im and im oga go address di situation if dem win.

E say im self for be di worse, almajiri from di North if no be say im get access to education.

E say dia administration go focus to comot plenti almajiris dem from street and put dem for school so dat dem go get beta future.

Rabiu also say dia administration go provide work for all young Nigerians to ensure say dem no put hand for any crime.

E also say im party go partner wit oda neighbouring kontris dem to tackle di security wahala wey Nigeria dey face.