You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Yemi Osinbajo helicopter crash: Video wey show wen di accident happun
Read am in 1 mins
Nigeria ruling All Progressive Congress don post one video wey dem say show di time afta wen di helicopter wey dey carry di number two man for di kontri Yemi Osinbajo crash land on Saturday, February 2.
Osinbajo bin dey go Kabba, Kogi State, North-Central Nigeria to continue im Next Level campaign wen di accident happun.
Im and im entire team wey dey inside di helicopter survive.
APC post di video ontop dia United Kingdom twitter account handle.
Di video show as pipo gada, rush di helicopter to bring di passengers out wit one man wey dey shout "Jesus, Jesus, Jesus" for di background.