Walter Onnoghen: How Nigerian lawyers comply wit order to shun courts for two days

Nigeria Bar Association say beginning from Tuesday 29 January lawyers go bone court across di kontri for two days to protest di suspension of Justice Walter Onnoghen as Chief Justice of Nigeria.
"We support make lawyers shun court but our customer interest come first", na wetin one lawyer tell BBC News Pidgin for Appeals Court inside Abuja on Tuesday.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 1
Tori be say inside di 36 states of Nigeria, no be all lawyers obey di order by join bodi of registered lawyers for Nigeria.
BBC News Pidgin enta some courts for some states find out some states obey di oda while oda no obey.
Lagos state
Lawyers for Federal High Court and National Industrial Court Ikoyi, Lagos obey di order as dem no follow do any court sitting on Tuesday.
"Court session no hold today sake of say na NBA get us and we dey obey dia order". Barrister Bright Aikhegbe tell BBC

For Ogudu Magistrate court Lagos, court dey in session wen our crew reach dia and lawyers dey inside court.
Dem claim say na criminal criminal case dem come treat and if dem no show face na di accused pesins go suffer.
End of Di one wey oda users dey read well well
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 2
Port Harcourt, Rivers state
Court sitting no hold for Rivers State sake of say di lawyers no show face.
Tori be say di judges show face but dem no fit hold dia sitting becos of di lawyers.

Some lawyers wey come di area but no wan make we record dia voice say dem dey obey di oda.
Some pipo for dia do demostration for street to put mouth for di mata.
Abuja
Some lawyers show face on Tuesday for Federal High Court Abuja come court but some of di judges no no do sitting except Justice Nyako.
Some of di lawyers say di NBA directive no get head as dem gaz comot to come look for dia daily bread.

Many of dem say first dia duty na to dia client and dat if dem get case today dem no go fit abandon di case.
For Court of Appeal Abuja, sitting neva begin wen our reporter come dia.
Tori be say activities for court premises no dey high as e bin dey dey for oda working days.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 3
Kano
Lawyers for Kano, north west Nigeria dey observe di NBA directive wey say make dem no go court for two days after President Buhari suspend Justice Walter Onnoghen as Chief Justice of Nigeria."NBA na dem dey stand for any lawyer if something happen to am, so we need to obey them if dem direct us, as you see me for court, i just come collect date for one client wey I get." Barrister Ma'aji tok.

Na di same tin Barrister Abubakar tok and e also add say dem dey against wetin President Buhari do.Na di same tori for National Industrial Court and Federal High Court wey dey for di same court road as di places dey very dry without any activity.















