Onnoghen: Nigeria lawyers dey protest Chief Justice suspension

Lawyers under di name of Lawyers in Defence of Democracy dey protest for di Abuja headquarters of di Nigeria Bar Association.
Di lawyers say dem want President Buhari to make U-turn ontop di suspension of Chief Justice Walter Onnoghen.
Na on Friday Presido Buhari suspend Chief Justice Onnoghen, afta di Code of Conduct Tribunal ask am to do so, sake of magomago case di judge get. Di president come appoint and swear-in Ibrahim Tanko Mohammed as acting Chief Justice.
But di lawyers wey dey protest want make di Nigeria Bar association call on lawyers to stop work. Dem also want di National Judicial Commission to expel Justice Tanko Mohammed.
As dem dey protest, anoda group come to protest in support of di decision wey Presido Buhari take to suspend oga Onnoghen.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Earlier, police officers bin dey ground for di national headquarters of di NBA, wia dia executive council suppose meet on Monday ontop di suspension of Chief Justice Walter Onnoghen.
One of di lawyers wey follow for those wey wan protest, say President Buhari do no follow due process.
E say goment don show say e dey bias and say before President Buhari fit suspend Onnoghen, im suppose write to Senate and 2/ 3 of di senators must vote am out before e fit suspend am.
End of Di one wey oda users dey read well well
















