Half of wetin e tok na true. Buhari dey correct say Nigeria get di world second position on top of di number of pipo wey no dey usee toilet. Na India be number one.
Ova 46 million Nigerians no dey use toilet, na wetin dey World Bank World Development Indicator database. Dis na almost one quarter of di kontri.
But for region dem, di numbers dey different . D three states wey get di highest rate for open defecation na Kogi, Plateau and Benue, wia e pass half of dem wey no dey use toilet, based on wetin WHO/UNICEF survey for 2016-2017 tok.
But for places like Borno, Zamfara, Kano, Abia and Lagos states, di mata be like night and day as na only fivepercent of people dey fo open defacation.
Today, open defecation for villages pass times two that pipo for township but di impact of pipo wey no dey use toilet na pipo fir for township go feel am pass, wey dey worry places like Lagos wey pipo full like sand.
Several kind yama-yama diseases like diarrhoea fit happun and spread for food wey don spoil or doti water for doti places dem, wey pipo no dey troway doti well, no dey take care of dem health, like dem no dey wash dia hands.
Buhari notice say Nigerians no dey fit find beta toilet like before and safe water for drinking and cooking.
Wetin di 2015 Joint Monitoring Programme of WHO/UNICEF (JMP) tok for dia study confirm am but di numbers dey different from wetin Buhari tok.
In 1990, WHO tok say around 38% of pipo get beta toilet, but only 25% get for 2015.
Yes of fight-fight don scata di infrastructure wey dey allow clean water and toilets especially for North-East areas.
Today, Nigerians for most of di states fit see clean water but no be piped water wey dey enta house direct wey be di highest level of service.
For di whole of Nigera, na only for Abuja wey more than 1 in 10 pipo dey see clean piped water wey dey enta dia house direct.
Oda Nigerians, wey be 1 in 3 dey get drinking water from tubewells and boreholes wey be aoda beta source of clean water.
For di north, 2 for evri 5 homes still dey find am hard to get clean water.