Oby Ezekwesili: ACPN candidate don step down from presidential contest for Nigeria 2019 Election

Oby Ezekwesili

Wia dis foto come from, Oby Ezekwesili

Read am in 1 mins

Ogbonge woman challenger Dr. Obiageli (Oby) Ezekwesili don step down as presidential candidate wey wan contest Nigeria 2019 general election.

Di ACPN candidate say she dey step down to join hands wit oda candidates for Nigeria wey go form alternative party wey go fit stand head to head wit di ruling All Progressives Party (APC) and main opposition, Peoples Democratic Party (PDP).

She announce say she no dey do again for her verified twitter account on Thursday morning.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Dis step down dey come just days afta madam Ezekwesili see as kontri pipo bin react to di 2019 presidential debate wey happen on Saturday 19 January.

Di former goment minister for Education don helep bring attention to hundreds of school girls, wey militants bin kidnap for north east, as leader of di Bring Back Our Girls group.

Meanwhile, anoda presidential candidate, Fela Durotoye of di Alliance for New Nigeria party, hail madam Ezekwesili for dis move. Im say im dey redi to do coalition tok-tok wit oda presidential candidates, Omoyele Sowore and Professor Kingsley Moghalu.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.