You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Serena Williams tumble comot Australian Open
Read am in 1 mins
Serena Williams tumble comot from Australian open on Wednesday afta Czech seventh seed Karolina Pliskova wipe her for di women's singles quarter-final match.
Pliskova beat Serena 6-4, 4-6, 7-5 to win enta semi final.
37 year old Serena Williams wey bin dey lead for early stages of di tournament wen she beat world number one Simona Halep for fourth round.
Pliskova wey be former world number one say di win na huge confidence booster before she go face US Open Champion Naomi Osaka semi final.