Nigeria 2019 Elections: 'Why I no show face for 2019 Presidential Debate' - President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, FEMI ADESINA
President Muhammadu Buhari don explain di reason why him no attend di Presidential Debate on Saturday night for Abuja, Nigeria.
Na Nigeria Election Debate Group and Broadcasting Organization of Nigeria na im organize di debate wey many pipo consider as di mama of all di presidential debate wey go happun before di 16 February, 2019 general election.
According to statement wey land from di All Progressives Congress Presidential Campaign Council, di President busy campaign schedule make Buhari enta Abuja very late in di evening wen di debate don already start.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Out all di five candidates wey di organizers invite, na Kingsley Moghalu presidential candidate of Young Progressives Party, Fela Durotoye, presidential candidate of Alliance for New Nigerian and Oby Ezekwesili of presidential candidate of Allied Congress Party of Nigeria show face for di debate.
APC Presidential Campaign Council say di president go Niger and Plateau states for north-central Nigeria go do campaign and also commission Baro Inland Water Port so dia waka no come give Buharitime to show face for di debate.
Di statement from APC Presidential Campaign Council say im just reach Abuja on Saturday evening and he don use other opportunities engage with pipo through town hall meeting for Wednesday January 16.
E add say im Vice president , Yemi Osinbajo also take part for di vice presidential debate.
Buhari also caution Atiku
End of Di one wey oda users dey read well well
Di statement also respond to di PDP presidential candidate Atiku Abubakar wey walk out of di debate because he no see Buhari.
Dem tell Atiku say, wetin him do don show say, PDP and Atiku wan use di 2019 elections attack Buhari.











