BBC Pidgin Governorship debate: "We go run Akwa Ibom goment like family" - Ekong Eyo

Read am in 6 mins

Ekong Eyo wey dey represent di Peoples Progressive Party for di governorship debate for Akwa Ibom state, south-south Nigeria don tok say na family style goment him wan run.

To am "na all of us dey di goment together and we be family and we go do dis tin together."

He tok dis one for di BBC Pidgin Debate wey happun on Thursday for Akwa Ibom State.

He also add say him go use farms empower di pipo for di state and dat jobs go help with increase revenue generation for di state. Eyo wey be investment banker tok say him go also use him experience help for di governance of di state.

Di BBC Pidgin Debate na chance for governorship candidates for di state to engage with di pipo for di state and to share di plans wey dem get for di state.

Akwa Ibom fit pay 'N100,000' Minimum Wage - Iboro Otu

Di issue of minimum wage come up for di BBC Govnorship debate on Thursday and all di candidates agree say di states fit pay di N30,000 minimum wage except one oda candidate wey tok say di state fit pay pass dat amount.

Iboro Otu governorship candidate of di Abundant Nigeria Renewal Party, Ezekiel Nya Etok from Young Democratic Party, Ekong Eyo of Peoples Progressive Party and Nature Udoh of Young Progressives Party ansa qweshion ontop dis salari mata

Eyo dey tok say goment fit pay am while Nya Etok dey convinced say wit di correct budgeting, im fit pay N40,000 minimum wage to empower junior workers.

Udoh gree wit am say if dey cut unnecessary goment expenses e go fit pay workers N90,000 as dia minimum wage.

Otu say as soon as im enter e go start to dey pay di N30,000 minimum wage and im go increase am to N50,000 for 6 months and before im leave office di minimum wage go reach N100,000.

"I wan groom young person wey go take over Akwa Ibom from me after 4 years" - Ezekiel Nya Etok

Governorship candidate Young Democratic Party for Akwa Ibom State, Ezekiel Nya Etok still maintain say young pipo na di reason why him dey run for governor, even though he resign as di party chairman for 2016 because he wan make dem take over.

He tok am for di BBC Pidgin Debate wey happun on Thursday for Akwa Ibom State.

Nya Etok tok say "Na me be di father of youth participation for politics and I come back because nobodi dey groom young pipo. I wan contest to show dem di way and groom dem so dem go take over afta 4 years."

He add say him wan introduce social governance to di state. Dis wan go ensure say everyone participate inside governance especially pipo wey no get di means and him call am di "bottom to top" approach.

Ezekiel Nya Etok na renowned arcihtect wey don do work for both public and private sector for Akwa Ibom state.

Akwa Ibom politicians dey tear eye for election becos of 'winner take all mentality' - Nature Udoh

"Di problem wey dey make politicians tear eye for election, na di winners take all mentality we get. Once dis parti win, dem wan chop alone"

Akwa Ibom Governorship Candidate Nature Udoh wey dey represent Young Progressives Party na im yan dis wan for BBC Govnorship debate on Thursday for Akwa Ibom state, South South Nigeria.

Udoh bin dey ansa kwesion for di debate ontop issue of political tension come up for Akwa Ibom state.

Di kwesion na why politicians dey against each oda during election?

Udoh sya "di problem wey dey make politicians tear eye for election, na di winners take all mentality we get. Once dis parti win, dem wan chop alone"

On top education mata di YPP candidate wan make goment restructure how education dey go especially for Akwa Ibom State.

He reveal dis one for di governorship debate wey hold today for Akwa Ibom State.

Udoh make reference to Benin Republic as im dey discuss him plan for education for di state. According to am, di kontri dey find ways to engage pipo wey no wan do white collar job with oda vocational skills.

According to am, afta pikin don reach a particula level, dem go get option to either continue for formal school or go vocational school. He also add di tok say "Anybodi wey sabi read signboard don go school."

Udoh also add say him go increase budget allocation for state budget and dis go help am increase teacher salaries for di state and to establish di vocational centres wey go train di pipo wey no one do white collar work.

Nature Udoh na business man we don also do work for pubic and private sector for Akwa Ibom State.

Four of di governorship candidates for Akwa Ibom state, South South Nigeria show for di BBC Pidgin debate wey happun live for Uyo.

Wetin dem yan?

All of dem also ansa kwesion ontop issues from Education to Employment and even Security for di state.

Economy

Economy na ogbonge mata for di debate as di candidates tok on di ways dem fit epp change di ecomony.

Udoh tok say im wan empower business pipo for di state as na dem fit improve di economy. E tok say e go create fund wey dem go fit access to get grants and loans.

Otu tok say im go create one million jobs for di pipo of di state and im go use data achieve am.

Nya Etok tok say im go do away with unnecessary special assistants and use dia money empower 3000 pipo to start dia business.

Education

Education also mean a lot to di candidates as dem tok di ways to dem go epp improve education for di state. Dem also agree say di moni wey current goment allocate for education dey small.

Otu wan transform di schools for di state to make am research centres where di pipo go fit learn ways to improve quality of life for di state.

E also add say when pikin finish from primary 6, e go give dem 1 million cellphones so dem fit access information from around di world.

Nya Etok tok say im go increase di salary for teachers for di state and e go create ICT centers for di schools.

For Eyo, supervision dey very important and im feel say di education ministry gats supervise di schools.

Udoh believe say di teachers no dey motivated so im go work on fixing dia pay. E also add say him go also focus on other forms of education like vocational skills wey go help pipo wey no wan work for office.

Oda foto from di debate as e happun