Amber Rose make $2m dollars a year from Instagram, how you fit make your own

Amber Rose

Wia dis foto come from, Amber Rose

Read am in 3 mins

One social media influencer for Nigeria don share some important tins wey pesin fit do to make money from social media.

Recently, American model and actress, Amber Rose reveal say she dey make around $2 million (£1.5m) a year from sponsored Instagram posts.

Di 35-year-old model wey get like 18.8 million followers for Instagram tell Van Lathan about di money wey she dey make during im 'Di Red Pill podcast.'

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 1

Ebuka Akara tell BBC Pidgin say first of all, pesin gats to get a niche- like wetin pipo know am for, wetin go attract pipo to go im page. Dis na oda tins wey pesin need to do;

  • You need to get interesting content everyday wey you dey post online. Na dis go make pipo dey come your page to come see wetin dey dia. Pipo go dey expect say you go dey bring out content everyday.
  • You need to get plenti followers wey go be your audience and na through di tins wey you dey post, you fit use take gada dis followers.

"Di more followers you dey get, di more dem go dey share your post and di more oda pipo go dey see am too.

"Brands, companies go come contact you to do advert for dem as e be say dem dey see say you dey create conversation, pipo dey tok to you and pipo dey access your page plus many pipo dey see wetin you dey post." Na dis brands, companies and media houses dey bring out dis money."

Amber Rose

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Amber Rose say she dey make $2 million a year from Instagram

Ebuka add say, di koko na to keep your page and content interesting, to make sure say everyday conversation dey. Because if di conversation for di page die, nobody go contact you.

Amber Rose sabi dey post all sorts of beauty, fashion and diet products for her Instagram account but pipo neva sabi how much she dey make from all dis posts.

She explain give Van say how she dey make dis money from Instagram na through "Posting and working wit brands, endorsement deals and stuff like dat".

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 2

Amber dey always posts sponsored posts for online retailer Fashion Nova, plus diet companies wey includ BoomBod and Flat Tummy Co.

She also dey team up wit sex toy company Lelo as spokespesin, and most times dey posts adverts for dem on her feed.

Skip Instagram post, 3
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 3

During di interview, wen Van Lathan ask Amber how much she dey make from Instagram, she reply say:

"Probably like $2 million a year, just off Instagram. Some girls dey wey dey make more than $2 million a year, I make $2 million on Instagram a year, yes."

Van dey very surprise wit di money wey Amber dey make so tey e come use joke tok say im wey go through college no dey make dis kain pepper off Instagram. E come later tell Amber she dey 'blessed'.