You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
New IG of Police: President Muhammadu Buhari don appoint AIG Mohammed Abubakar to replace IGP Ibrahim Idris
President Muhammadu Buhari on Tuesday appoint AIG Abubakar Mohammed Adamu to replace Nigeria Inspector General of Police Ibrahim Idris wey don retire.
President Buhari decorate di new Inspector-General of Police, Abubakar Mohammed Adamu Tuesday afternoon for Aso rock.
Abubakar promise to tackle Nigeria security wahala wen im tok wit tori pipo afta president Muhammadu Buhari decorate am
"I go restrategise to solve kidnapping, abduction and other security wahala" im explain.
By dis appointment, oga Adamu climb 30 oda Assistant Inspector Generals, overtake seven oda of im seniors wey be Deputy Inspector Generals to become dia oga.
Oga Abubakar say im go follow all di arrangement wey di former IGP Ibrahim put for ground on top election mata and im go make sure say im ensure free, fair election for February dis year.
"I assure new political parties wey di participate for dis election, dat as professionals, di police go kontinu to play by di rules, we go do di right things"
"We go ensure say we follow di ethics of our job and ensure say all politician get the same level playing ground" im explain.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say di president of Nigeria get powers by law to appoint pesin of im choice as di Inspector General of Police.
IGP Ibrahim Kpotun Idris hand over to Assistant Inspector General of Police, AIG Abubakar Mohammed Adamu as Acting Inspector General of Police, according to order from President Buhari.
Di Senate go still need to approve di appointment before di Acting Inspector General of Police go turn to Inspector General of Police.
Na 22nd June 2016 na im Ibrahim Idris wey wey retire on Tuesday 15 January 2019 bin start work as new oga of Nigeria police.
Oga Idris dey retire now onto say im don clock 60 years of age.
Who be AIG Abubakar Adamu Mohammed
Nigeria Acting Inspector General of Police, Mohammed Abubakar Adamu come from Lafia, Nasarawa State for north-central Nigeria.
Di new police oga for Nigeria get university B. Sc degree for Geography.
According to Nigeria Police tok-tok pesin Jimoh Moshood, di new police oga join police on 1st February, 1986 as Cadet Assistant Inspector General of Police.
Ag. IGP Adamu don get plenti experience, e attend plenti Senior Officer Courses on Law Enforcement, Crime Prevention, Control and Management within and outside Nigeria.
Before im new appointment as Acting Inspector General of Police,na im bin dey lead Staff at the National Institute for Policy and Strategic Studies (NIPSS), Kuru, Jos, Plateau State for north central Nigeria.
Oga Adamu don be Commissioner of Police inside Ekiti southwest Nigeria and Enugu State Southeast Nigeria and also Assistant Inspector General of Police in charge of Zone 5 Police Command Headquarters, Benin, Edo State, south-south Nigeria.