Misimi Isimi: "Dem dey call me Miss Environment because I dey fight dirty"

Wetin we call dis Video, Misimi Isimi: Pipo dey call her 'Miss Environment' because she dey fight dirty

Misimi Isimi na 11-year-old environmentalist wey dey determined to fight pollution for Nigeria.

Dem sabi her for area as Miss Environment.

She love to teach oda children about di environment, she say some adult no dey "environmentally responsible" and she dey "on a mission to save Lagos."