You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Adekunle Gold and Simi: Five Nigeria celebs wey do secret wedding
Rumour dey fly upandan for social media about Nigeria celebs Adekunle Gold and Simi unto say dem marry today for secret wedding.
Even though two of dem neva come out to tok weda na true or not, one source wey close to di couple tell BBC Pidgin say, true-true di wedding happun and na 300 pipo show to follow dem share dia joy.
BBC never fit independently confam dis tori.
Secret wedding common for among Hollywood celebs but dis days Naija celebs too don follow dey hide do dia weddings too.
D'Banj
Famous Nigerian Afro pop star D'banj A.K.A Koko master, bin hide im marriage to im girlfriend Lineo Didi Kilgrow.
D'Banj marry im wife on 2 July, 2016 for small ceremony.
Uche Jumbo
Afta her relationship wit Super Eagle star Ikechukwu Uche scata, she jejely go America go do secret wedding.
Uche marry her Puerto Rico boyfriend on 16 May 2012.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di'ja
Na for December 2015, popular Musician Dija quietly do her wedding but pipo no sabi say she don marry until July 1, wen she come out to tell di world say she don marry and she get baby boy.
Agbani Darego
Ogbonge Nigeria model and Miss World 2001, Agbani Darego, waka go Morocco marry Ishaya Danjuma di son of billionaire Theophilus Danjuma, for April 2017.
Tori be say na only 35 pipo dem invite for di wedding.
Joseph Yobo
Former Nigeria international footballer Joseph Yobo marry 2008 Most Beautiful Girl in Nigeria, Adaeze Igwe for midnight ceremony for Jos, North Central Nigeria for 2010.
For 2014 dem list Adaeze as di number four most beautiful Africa sportsman wife.