President Buhari Interview: "E beta to get N18,000 dan to get nothing"

Wia dis foto come from, Arise TV
Nigeria President Muhammadu Buhari don tok say e better make workers get N18,000 minimum wage than to get nothing.
Di President tok dis one for one interview wey local tori pipo, ThisDay Newspaper and Arise TV talk say im grant dem. President Buhari tok am wen di journalists ask am weda im think say N18,000 dey decent as salary wey any Nigerian suppose get.
As im dey answer dat question, President Buhari tok say di fact wey dey ground be say we get more unemployed pipo for Nigeria dan di people wey dey employed.
Di President come add say even now, some of di states no fit pay minimum wage. "There are states dat are owing up to 6 months salary now...now if I say make them pay N30,000 and dem no fit pay...I think e better to get N18,000 dan to get nothing."

Wia dis foto come from, Getty Images
During di interview, President Buhari tok about plenti oda issues wey dey worry di kontri wey also make plenti pipo dey hala.
One of di issues wey im torch light na security for di kontri. Di President talk say di number of pipo wey Boko Haram don kill for Taraba and Benue put togeda no reach di one wey don die for Zamfara State.
Nigerians dey react on top President Buhari interview with Arise TV
Nigerians for social media don dey react to President Muhammadu Buhari interview wey dem show for Arise TV on Monday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Before dem begin air di Interview, Arise TV presenter, Charles Aniagolu, yan say di presido no gree appear for live interview but prefer to hold recorded session instead.
Dis alone don get plenti reactions from pipo as to why di presido go choose recorded option.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4
During di interview, President Buhari also tok say im goment don achieve food security and make fertilizer available half di price dem take meet am.
"We no dey import rice again and we dey even export grains but we want to be self-sufficient in maize so dat di chicken feed go dey plenty yanful-yanful. We don try well-well for Agriculture."
E add say pipo no dey depend on oil like before again.
Dis one don cause some reaction for social media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
E say Boko Haram before now dey occupy 17 local goment for North East, especially for Borno and Yobe State but now physically dey dem no dey occupy any local goment.
Di president also add say di way leadership of Benue and Taraba dey report about killi-killi for dia state no dey fair to Nigerians because dem dey give am religious and Ethnic twist.
"But wetin di leadership of Benue and Taraba dey report, dem dey give dis killings religious and ethnic twist and dis dey very unfair to Nigeria"
Other reactions wey di interview don cause still plenty like di following ones:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 6

End of X post, 7
As all dis killi-killi dey happun for di country, di president also tok about why im neva still change Service Chiefs .
"I accept responsibly for no change...when you get case of emergency you need to dey careful to tamper wit di head of security service and dis na one of my personal experience," na so di President talk.
"We get many ambitious pipo wey dey wait within di service but only one man na im fit be chief of army staff, only one man na im fit be chief of air staff, only one man na im fit be IG. No forget say na dis administration na im appoint dem."
"I no know dem personally. I dey follow records and I tink I pick di best. Of course, dia performance fit dey fall hand but I accept responsibility for say I neva change dem," di President add.