You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Don Jazzy say 'Mavin Records neva die, we just faint small'
Mavin Records oga and music producer, Don Jazzy call on Nigerians for serious prayers on Tuesday to revive im record label.
Evritin start wen one Ambrose Okwoli Junior for Twitter ask Don Jazzy weda in record label don die abi na di 'Buhari change' dey worry am.
Don Jazzy start Mavin Records for 2012 afta im former Mo'hits label pack up.
Don Jazzy answer am say Mavin Records neva die, say na just small faint dem faint.
Some pipo feel say Mavin Records no too dey make noise as dem dey do before, wey make dem dey wonder weda di record label don die.
Some popular artistes wey bin dey di Mavin Records label na Wande Coal, Tiwa Savage, Korede Bello, Dr SID, Di'Ja, D'Prince, Reekado Banks, Johnny Drille and some oda artistes.
But some artistes don dump di label like Wande Coal and Reekado Banks wey just waka comot on December 7, 2018.