Daily Trust: Why we close down di newspaper offices - Nigerian Army

Wia dis foto come from, Nigerian Army
Nigerian Army don explain why dia sojas carri force enta di offices of Daily Trust Newspapers for Maiduguri, Abuja, Lagos and Kaduna on Sunday.
Pesin wey dey tok for Army, Brigadier General Sani Usman, say "soldiers of di Nigerian Army wit Nigeria Police Force and oda security agencies bin dey di Abuja and Maiduguri offices of di company to invite di staff becos of dia story on Sunday Trust publication."
Oga Usman say di story reveal secret military information, wey threaten national security.
Di army tok-tok pesin accuse di newspaper say dem reveal wetin military don plan for dia operations against Boko Haram. Im also say di tori alert Boko Haram of Army plans.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Late on Sunday evening, Nigeria presidency put mouth for di mata, say di Federal Goment don order di army to vamoos for di newspaper offices, say make dem use tok-tok settle dia kwanta.

Wia dis foto come from, Daily Trust
Armed soldiers on Sunday raid Daily Trust tori pipo head office for Abuja, Nigeria pack all dia office equipment comot, move everibodi out and lock up dia office for 20 POW Mafemi Crescent off Solomon Lar way, Utako district.
E happun afta soldiers go Daily Trust regional office inside Maiduguri, Borno state, northeast Nigeria wia dem arrest di regional Editor, Uthman Abubakar and one reporter, Ibrahim Sawab.
Daily Trust na private newspaper for Nigeria wey many retired journalist come togeda to form. Na since 1998 dem don dey in operation.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say soldiers close down di gate of di Maiduguri regional office, afta dem arrest di two editorial staff wey dem see for di time of di raid.

Wia dis foto come from, Daily Trust
Daily Trust tori pesin tell BBC Pidgin say:
"Security agents wey include DSS, Police and military men by force demsef enta our building and arrest our regional Editor, Uthman Abubakar plus one of our reporter, Ibrahim Sawab.
"Afta dat dem pursue all di staff comot from di office plus including di security guard, and dem decide to lock and close down di Borno, Maiduguri office.
"And we dey try to reach out to di oga dem for di military to get dia reaction and to know wetin to do next but dem no greet tok to us.
"Just dis evening some minute ago dem invade our head office for Abuja. Dem by force all di staff to move go di ground floor and dem dey harass pipo dia because na by force dem use to enta di building.
"Wetin we dey suspect be say dis raid fit dey connected to di cover of our today story. We bin do one tory wey give detail of some of di military operations wey don happun for North East, especially wit di recent Boko Haram for North East."
"Because we hear say wen dem raid our Borno office, dem ask about one of our editor wey bin di pesin wey anchor dat story."

Dis no be di first time Daily Trust dey suffer dis kind of harassment, military bin don first trouble dem during close to di 2015 election.
Dis tin wey happun to Daily Trust dey come just weeks afta di military use hurry-hurry suspend UNICEF on top di same Boko Haram mata but dem quick-quick make U-turn cancel di suspension.











