Pant tiff-tiff for Nigeria suppose be attempted murder case - PPRO

Wia dis foto come from, Instagram/@opetodolapoofficial
One Public Relations Officer for Lagos, Nigeria tink say she get di solution to stop di tiff-tiff of pant for di kontri.
Dolapo Opeto Badmus tok on top social media say, "From now any pesin wey dey iff pant no suppose receive stealing accuse but attempted murder accuse".
E don become wetin pipo dey tok about for social media plenti-plenti with advise like wen you wan troway old pant burn am so pesin no go fit use am.

Wia dis foto come from, Instagram/@opetodolapo
Tori be say if pesin tiff your pant afta some time di owner of di pant go die as dem don use am to do money rituals.
But pipo don also call out Madam Dolapo on top wetin she tok. Dem say no be so law dey work at all.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2